26 June 2020

Lagos state goment don confam di cause of death of di former Oyo state govnor, Senator Abiola Ajimobi.
According to statement from di Commissioner of Health of di state, Prof. Akin Abayomi, Ajimobi die on Thursday, June 25, 2020 for First Cardiologist Consultant, one private COVID19 approved care facility for Lagos state.
"Di former govnor die from multiple organs failure afta complications from Covid-19 infection,"
"On behalf of di Covid-19 Lagos incident Commander and di entire Covid19 Lagos response team, we convey our heartfelt condolence to di family of di former govnor and di pipo of Oyo state". Di statement tok.
Skip Twitter post, 1Allow Twitter content?Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Accept and kontinuEnd of Twitter post, 1
According to Islamic rite, di burial suppose happun inside 24 hours afta im die.
But tori be say dem go bury am for Ibadan, Oyo state on Saturday 27 June, so dat coronavirus team from Lagos go come bury di bodi properly.
Meanwhile pipo don dey react to di death of di All Progressive Party chieftain.
Nigeria president Muhammadu Buhari wey say Ajimobi comot di world at a crucial time for di party and di kontri wen dem bin need am to heal and grow, say im contribution to di development of Oyo state and di nation na something wey go always dey remembered.
Oyo state Govnor Seyi Makinde don direct make flags fly at half mast in honour of di death of Ajimobi wey im call statesman.
Skip Twitter post, 2Allow Twitter content?Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Accept and kontinuEnd of Twitter post, 2
Governor Adegboyega Oyetola of Osun State tok for statement by im Chief Press Secretary, Ismail Omipidan, say Ajimobi death dey 'unfortunate, painful and a great loss.'
While former Lagos State Governor, Mr. Akinwunmi Ambode, say di death of Ajimobi na personal loss.
Meanwhile di Governor of Lagos State, Mr Babajide Sanwo-Olu, express sadness over di death of di former governor.
Sanwo-Olu, inside statement by im Chief Press Secretary, Mr. Gboyega Akosile, say Ajimobi death despite efforts to stabilise am wen im sick, don open deep sore for di hearts of Nigerians.
ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmraeinnp2f5BxcG1pYQ%3D%3D